Our Feeds

Tuesday, 5 February 2013

Unknown

Pidgin for laugh it off is superb

E get one particular restaurant
wey i dey
chop 4 GRA,
E get one oyibo wey
dey always come chop there
too...
... Any tym dis oyibo chop
finish he go shout '' Hey'',
so I
wonder wetin dey make am
shout,
i decide to chop wetin d
oyibo dey always chop so
maybe me self go shout
too..
when i reach d restaurant last
wk friday,....
i order wetin d man
dey chop..
Dem tell me say na
chicken & red wine, so i chop am,
but i no shout,
i colet xtra plate,
but i stil no shout..
na then i just
vex ask 4 my bill.
D waiter tell me
say one plate of chicken & red
wine na N75,000 then d xtra
plate na another N75,000....
na then
i shout heyyyyyy
heyyyy
heyyyy
heyyyyyyyyyyyyy yyyyyyyyyyyyyyy
yyyyyyyyyyyyyyy yyyyyyyyyyyyyyy
yyyyyyyyyyyy,I still dey shout till
now.
Sent from my BlackBerry wireless device from MTN

Subscribe to this Blog via Email :
Previous
Next Post »

Please drop your comment.